The Independent National Electoral Commission don carry the deadline for PVC collection go front by one week.
For one statement wen Festus Okoye wen be the National Commissioner, Information and Voter Education sign, dem yarn say the exercise wen suppose end on Sunday January 29 go con end on Sunday February 5.
“The Commission meet today Saturday 28th January 2023, a day after we don meet with the Resident Electoral Commissioners (RECs) from the 36 states wen dey Naija and from Abuja too where we take discuss many issues like the report from all the RECs for PVC collection for all the 774 local Government Offices wey dey Naija.
“We go remember say for the meeting with RECs on Friday January 27th 2023, INEC Chairmo, Prof Mahmood Yakubu con make am clear say dem no go mind use any oda plan wen dem see to take make sure say evri for Naija get enough chance to collect their PVC before the general election.
“Based on the reports wen we don look from all the states wen dey Naija, INEC dey encouraged by the way Naija people dey troop dey go collect their PVC. Based on the reports from the different states and the discussion with Resident Electoral Commissioners, INEC don decide to carry the deadline of PVC collection for local government offices go front by one week.”