
Everywhere swellup kpukpukpu with security pipo, for the zonal seketaria of PDP for Port Harcourt as dem wan screen pipo wey wan be govinor.
Pipo wey wan be govinor for Rivers, Bayelsa, Akwa Ibom, Delta, Cross River, and Edo state don already land the venue, wey be the party zonal seketaria for Aba Road inside Port Harcourt.
Security full ground brekete plus olokpa, DSS, and mobile police wey stand for the gate. If you nor fit tok who you be na outside get am.
Some pipo wey wan come out as govinor for Rivers State, na the foma state chairmo of PDP, Felix Obuah, Senator Lee Maeba, foma Transport Minister, Dr. Abiye Sekibo, David Briggs and some other pipo.