Niger Delta Commission nor gree for the result wey INEC bring for the presidential election wey happen on Saturday, dem see na the worst election be this for Nigeria.
For statement wey dem bring on Monday, NDC say even as plenty pipo dey get hope for the election as Buhari govimet nor gree do free and fair election dem come out to vote but na anoda tin dem dey see.
The Commission still call the staff and personnel of the Independent National Electoral Commission, INEC, as dem dey do wayo for the election result and dem nor even folow wetin dem tok.
But for anoda side, the National collational centre say dem go start to count the result again around 11 today to start with the announcement of the results.