+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

2023: Seun Kuti And Peter Okoye Clash Cus Of Peter Obi

 

 

 

As tension dey rise cus of the election wey dey come, e don rise reach where Seun Kuti and Peter Okoye of P-Square as the two musicians just dey do tok your own make I tok my own about Labour Party presidential candidate, Peter Obi.

The mouth fight start afta interview wey Channels Tv tori pesin Seun Okinbaloye do with Mr Kuti and na there Kuti come say na only Nigeria pipo for save Nigeria.

Seun Kuti na Fela Anikulapo Kuti piken, hin say Peter Obi nor fit save the kontri and na just opportunity hin jump enta dey use.

Hin say: He neva get the time cus he nor quick start. You nor fit tell me me say cus you nor win PDP primaries, 18months before election start nai you start movement and you say you get plan for the kontri.

“That one na just who dey look for opportunity. And nor be pesin wey dey wan use Nigeria we dey find. No be to jump enta Labour Party. Labour Party get social structure. Peter Obi na capitalist. Where dem dey go?”

But wey Paul Okoye wey dey support Peter Obi hear wetin Seun Kuti wey dey play saxophon tok, hin say Kuti just clean hin papa history.

For Twitter post, Okoye come write, “Bros just shut up! You just fall hand! Bros don clean hin papa name from history! You say na only Nigeria pipo fit save Nigeria! PO and the other candidates dem nor be Nigeria pipo?…. SHAME! SHAME!! SHAME!!!”(sic)

That na wetin Peter Okoye write.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM