Kpoko for you,your teeth complete.Ogbonge yans! Ogbonge music! Ogbonge informate! Ogbonge radio! Na we be di one and only pidgin radio station for Delta State.
Kpoko FM come into existent for February 1, 2016 since then wafi people dey girate ontop confam gbedu and informate wey dey make dem updated regularly.
FAQ
How I go tey advertise?
If you wan advertise with us, our sales team go discuss with you. Dem go give you suggestion on how your message go reach the right people at the right time for shekele moni.
How I go tey talk to my favorite presenter?
You fit contact the presenter through the OAP page or call our number 09096611005, 09097711005
How I go tey do song request?
You fit send your song request to us directly to our e-mail info@kpokofm.com or our social media handles (Facebook:Kpoko100.5FM) and we go ssama you with the song.
Any Job Opportunities?
You sabi talk,you sabi do marketing, you dey creative oya talk to us directly. Opportunities dey for marketing,presenting,administrative duties and IT department.