Action Alliance say dem nor want the case against INEC and Bola Tinubu again for court.
With dem lawyers with Oba Maduabuchi, SAN wey lead dem on Monday nai the party take say dem nor wan kwatinue with the mata against the president elect small time afta the petition election court start.
The SAN lawyer tell the court say na for May 3 nai dem take write say dem nor want the case again.
But Justice Haruna Tsammani wey dey lead the five-member panel nor gree komot the case afta no bodi say no.
AA party don bin tok for dem petition for had in the March 16 say dem candidate, Solomon Okanigbuan, suppose dey for the election but INEC nor gree put hin name.
Dem still say pipo nor vote for Tinubu according to wetin the Electoral Act, of 1999 Constitution tok and and INEC for the 2023 general elections.