Afenifere Don Remove National Officers Cus Of Statement Wey Dem Tok Against Iwuanyanwu

Afenifere, Yoruba socio-political organisation, don  suspend two of dem national officers cus dem use word wey nor good take tok to Emmanuel Iwuanyanwu.

The officers na Jare Ajayi, wey be the national publicity seketary, and Abagun Kole Omololu, the national organising seketary.

The organisation release the information for dem end of month general meeting on Tuesday.

For the statement na Ayo Adebanjo, the Afenifere leader, and Sola Ebiseni, the seketary-general nai sign am.

All this upandan dey happen afta Emmanuel Iwuanyanwu tok say pipo wey dey cause problem between Igbo and Yoruba for Lagos na just political jaguda.

Cus of that tok of Iwuanyanwu, Omololu write statement on behalf of Afenifere dey condemn the Ohanaeze leader, and the  Yoruba socio-political group go meet Ohanaeze Ndigbo to  as wetin that kind tok mean.

But to kanter wetin Omololu write for statement, the group say nor be dem send am, as na ofrefre nai push Omololu and Ajayi take go write statement wey dem nor send dem.

The group say dem don look the video wey Iwuanyanwu take tok and notin bad dey inside he tok, nai make dem suspend the two seke.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM