Many pipo wey dey protest for Abuja street under the canopy of The Natives, on Monday to warn opposition parties wey dey say make INEC put anoda govimet wey go stay first small before the real govimet go enta.
Dem say dem stand with INEC chairman Prof. Mahmood Yakubu, and pipo wey say make he resign na just bad belle pipo.
This their standing by INEC chairman dey come afta some pipo under the umbrella of National Youth League for Defence of Democracy go protest for Unity Fountain for Abuja four days ago, say make DSS come arrest Yakubu cus of how he run the 2023 elections.
The group still say make President Major General Muhammadu Buhari (retd.) cancel the election and put govimet wey go run the office afta hin komot on May 29, untill the real govimet go enta.
But as the Natives dey waka for Abuja on Monday, dem say dem go do anytin to stop who wan stop the President-elect, Asiwaju Bola Tinubu make he nor enta office.
The Coordinator of the group, Smart Edwards, folow tok urge Presido and international community make dem nor ansa pipo wey dey say make dem cancel the election.
He say Nigeria nor fit repeat wetin happen for June 12 1993.
Edwards come still say dem nor tiff any mandate and e go be like say the opposition parties nor really tok dem mind to Nigeria pipo well or na dem members nai dey work against the interest of the party.