APC executive committee for Aniocha North don cancel the suspension wey Onicha-Olona ward 04 executive committee give Ms Lauretta Onochie.
For statement wey Matthew Chinye and David Onwuamaeze wey be the party local govimet chairman and seketarty, yesterday say “the ward executive match line as dem nor first come tell dem the tin wey Madam Onochie to the local govimet executive, the bodi wey dey in charge of section 21 of the party constitution, but dem do dem own and put the state executive committee for one side.”
Dem still say the many pipo wey sign the letter na just fake pesins wey go against the section of the party constitution.
The statement come say the local govimet executive committee go set up disciplinary committee to check wetin really happen.