+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Appeal Court Give INEC Go Ahead To Restart BVAS

 

Court of Appeal for Abuja don gree make INEC restart the Bimodal Voter Accreditation System wey be BVAS wey dem use for February 25 presidential election.

The three-member panel of justices wey Justice Joseph Ikyegh lead nai tok on Wednesday say the re starting of the BVAS na to epp the govinorship election for March 11.

The panel nor gree make dem stop INEC to restart the BVAS.

The panel say INEC submit say the accreditation data wey dem use for 176,000 BVAS for the election dem go save am for the backend of dem server, and Obi and LP gree.

Dem come still gree make Bola Tinubu and APC still check the sensitive materials wey INEC use for the presidential election so that dem go use am defend demsef for court.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM