+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Army See 1,671 PVCs,  Ballot Papers For One House Inside Lagos

 

Army Brigade catch some pesin wey get 1,671 Permanent Voters  Cards,  yesterday for one house for Olodi-Apapa area for Lagos State.

Three pesin nai dem catch for the house why the real pesin wey dem dey suspect don already gbess

Dem see ballot papers, cutlasses and Indian hemp for the house.

Vanguard tok say army get to know afta dem get to know about the hose for one investigation wey dem do for the area yesterday.

The Brigade Commander, Brig. Gen. Isang Akpaumontia, parade the suspects and the PVCs, wey dem tiff plus ballot papers and other tins before Tori pipo reach Ikeja Cantonment.

The PVCs get year 2022 as the registration nuba, 2011, 2012 and 2021 nai dey inside and the pipo wey get am dey stay for Lagos.

Wey Akpaumontia dey tell news pipo yesterday, hin say: “Three young men nai we arrest with over 1,671 PVCs.  This na afta we get info, with the epp of DSS nai we take catch dem.

“We cacth dem with some drugs, daggers, charms and over 1,000 PVCs.  na for Apapa general area we take arrest dem and the house owner still dey eun.

“We go karey dem go headkwata cus dem nor go just go free like that.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM