Naija inflation rate don climb go one 30-month high, as e rise more go 14.23 percent for d month of October and dis one na the latest figures wen show from the National Bureau of Statistics (NBS). The report wen dem publish for the website of the bureau show say the new inflation rate dey 0.52 percent points higher than the rate wen dem record for September 2020 (13.71 per cent). The figure rise by 1.54 percent between September and October and dis one show 0.06 percent rate higher than the rate wen e take rise between September and August (1.48 percent).
2.5 million naija children dey suffer from malnutrition
2.5 million Nigerian children wen dey under the age of 5 years dey suffer from Severe Acute Malnutrition (SAM). Na Prince Clem Agba, Minister of State for Budget and National Planning nia drop dis tatafo wen dem dey open the 2020 Nigeria nutrition week for Abuja on Monday. The minister say undermining d serious efforts wen dey government dey make for recent years most especially for the areas of child nutrition and breastfeeding, he say malnutrition (and other public health issues) still remain a challenge”. Meanwhile, this figure don place Naija as the country with the second highest number of children wen no dey grow well for the world.
Increase of fuel price go soon enter our body-Timipre Sylva
The Minister of State for Petroleum, Timipre Sylva don talk say Nigerians go soon get used to increment for d price of fuel. Sylva yarn dis one for one interview wen he get with State House correspondents after he don meet with President Muhammadu Buhari for the Presidential Villa, Abuja. He come still talk say d petrol price go always increase whenever oil rate go up
Focus on agencies wen go bring gbewu money- Senate tell acting Auditor general
The Senate don tell the acting Auditor General of the Federation, Mr. Adolphus Aghughu, to focus more on the financial activities of big agencies wen dey generate revenue wen gbewu instead of smaller ones. Na Chairmo of d Senate Committee on Public Accounts, Senator Matthew Urhoghide nia make d statement during the 2021 budget defence of the Office of the Auditor General for the Federation. Urhoghide come tell the AuGF to make sure say dem do thorough auditing of the accounts of the Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC), the Nigerian Ports Authority (NPA) and the Nigerian Maritime Administration and Safety Agency NIMASA, plus including others.
Man light fire for im and im babe body
One middle-aged man light fire for himself and him babe body for the High-Level Area of Makurdi town, after the two both of dem get better argument. People wen dey around wen d matter play say d two of dem don dey date for a long time and say na so dem dey always dey quarrel. “Them say dis time as dem start to dey quarrel again, everywhere come quiet like say dem don settle, at once nia d guy man come lock d babe for inside him room go buy fuel. Neighbors come see am with the gallon of fuel thinking say na for the generator only for am to enter the house, baff himself and d oshere with the fuel nia he light fire and na so d two of dem take burn.
Gernot Rohr: Osimhen go miss d Free-town game
Naija coachee Gernor Rohr don talk say Napoli striker Victor Osimhen go miss their 2022 Africa Cup of Nations qualifying match against Sierra Leone on Tuesday. Osimhen dislocate him shoulder for the Samuel Ogbemudia Stadium on Friday and na so dem immediately replace am wit Paul Onuachu. Rohr come still talk say Leon Balogun and Samuel Chukwueze dey recover well and say dem go make the trip go Freetown.
Reason with the demand of the youths-CAN Presido tell federal government
Presido of the Christian Association of Nigeria (CAN), Samson Ayokunle don tell the federal government to sharp sharp reason meeting the demands of the youths wen involve for d protests against police brutality for the country of recent. The man of God come talk say the youths dem dey cry out and say dem need attention. Mr. Ayokunle come still encourage Nigerians most especially the youths say make dem no give up.
Ooni of Ife tell FG to create job for naija youths
The Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, Ojaja II don tell government for all levels say make dem create employment opportunities to take cool down the minds of Nigerian youths wen dey binu and wen dey H so dat casala no go burst out. Wen the king dey yarn the beginning of him fifth year anniversary, he come talk say he don conclude plans to empower 5000 youths so dat dem go fit dey get their own money. For one statement wen d king otota Moses Olafare drop on Sunday, d king say need dey to continue to dey engage d youths for the country by creating meaningful employment opportunities for them.
Super Eagles go jam Sierra Leone for field today
The Super Eagles of Naija go get am hot with the Lone Stars of Sierra Leone today 13th November 2020 for one 2021 AFCON qualifier. The match go happen around 5pm and na for d Samuel Obgemudia stadium for Benin nia e go for take hold. Nigeria currently dey top group L with six points after two rounds game wen dem don play.
Governor Okowa don congratulate Edo state governor for him inuaguration
Governor Ifeanyi Okowa don congratulate him Edo state governor, Mr. Godwin Obaseki and him Deputy, Comrade Philip Shaibu for their inauguration for second term on Thursday. For one statement wen Okowa Chief Press Seceto Mr. Olisa Ifeajika drop, the governor say Obaseki wen come again for another term for office na make sense something. He come hail Obaseki for the way he take make Edo Great Again wit him vision wen according to am, go help for the industrialisation of the state.