The Delta state government don talk say the state tertiary institutions go resume academic work on the 2nd of October 2020. The report come after them close schools for the state based on corona matas. The state commissioner for Higher Education nai yarn this one for one interview with Niger Delta Today.He clear am say […]
Eat wetin we get
President buhari don talk say make naija people Eat wetin we dey produce for naija here. He yarn say as e be so, dem no go reopen border now. Presido for the meeting wen him and Ghana presido,Nana Akufo-Addo attend for london con clear mattas say when some motor dey carry rice and other food […]
Delta state government don carry curfew from 10pm go 12am
The Delta state government don change curfew time. Na the state commissioner for information, Mr. Charles Aniagwu yarn this one for one press conference for Asaba. He talk say based on the directive from the presidential task force on covid-19, the state government don change curfew time. The new time na 12midnight to 4am. He […]
Delta State don open youth parliament
The Delta State government don open the first assembly of the state youth parliament. This one take place on Tuesday for the state house of assembly complex. Dr. Ifeanyi Okowa wen Chief Funkekeme Solomon represent for the assembly con talk say this administration dey do everything wen Dem fit do to give youths opportunity through […]
House of Reps go pass the water control bill- Sada Soli
Sada Soli, one member for the house of representatives from Katsina state don talk say the lower legislative chamber go pass one bill wen dey seek to regulate water resources for the country. The bill dey seek to bring all water resources – both surface and underground — and the banks of the water sources […]
The Opposition dey play dirty politics-Lai Mohammed
Alhaji Lai Mohammed wen be d minister of information don talk say the opposition dey play dirty politics with the new electricity bill and d increment for petrol price. Wen Mohammed dey yarn for one press conference on Monday for Abuja, he come talk say subsidising petrol no go fit work again becos of d […]
NSE suspend trading for six companies
The Nigerian Stock Exchange (NSE) don suspend trading for six companies becos dem no file their audited financial statement for the year wen end on December 31, 2019. The NSE say dem make the move becos the companies no gree obey d corporate governance rules wen say dem must submit financial statements within a particular […]
Delta State government don approve construction of the Ogheye ultra modern market-Charles Aniagwu
The Delta State Executive Council don approve the sum of N4 billion for the construction of Ogheye Ultra Modern Concrete Floating Market project. Na d commissioner for Information for the state, Mr. Charles Aniagwu nia drop dis informate for one post-Exco press briefing wen shele yesterday for Asaba wen be d state capital. According to […]
PPMC don increase petrol price
The Petroleum Products Marketing Company (PPMC) don increase the ex-depot price of petrol from N138.62 to N151.56 per litre. The ex-depot price nia be the price wen dem take dey sell d product dey give marketers. Meanwhile na the PPMC, when be one branch of the Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) nia announce the new […]
Arsenal don sign Gabriel Magalhaes
Arsenal don confirm the signing of Gabriel Magalhaes from Lille. The defender ball enter d club for one £25 million deal and he don sign five-year contract with the Gunners. Meanwhile, he don become the club second signing of the transfer window, based on say dem don first kpake Brazilian player Willian on top free […]