Awka-Ibom, Hilda Bassey The Cooker Don Break World Record

Hilda Bassey Effiong wey like to dey cook and pipo know am as Hilda Baci, wey come from Akwa-Ibom state, don broken the Guinness World Record (GWR) for pesin wey stand dey cook for long time.

Na today, (Monday) early mormor for Amore Gardens for Lekki inside Lagos nai she take break the record.

The name of the competition nai cook-athon and e start on Thursday around 4:00 for evening as Baci on her gas.

Baci wey be pesin wey like cooking say she wan win Lata Tondon from India wey use 87 hours 45 minutes take win the Guinness World Record for 2019.

But on Monday the table don turn for Nigeria as Baci time don pass Tondon own to take put as the longest cooking marathon wey one pesin individual.

Normally Baci suppose stop wey she reach 97 hour time but she don break the record.

Share On:

1 Comment

  • Foster chigbo

    Nigerian no de carry last for anything dem do.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM