Kidnaper don tiff 10 skool children for Kachia LGA for Kaduna State.
The Kaduna State Govimet say dem get news from security agencies say bandits tiff 10 students for on Kachia LGA.
Na the Commissioner of Internal Security and Home Affairs, Samuel Aruwan, nai tok am for statement on Tuesday.
The tori say na on Monday nai bandits take tiff the day students of Government Secondary Skool wey dey for Awon.
He say dem never know the exact place wey dem tiff the students weda na inside the skool or outside.
The commissioner say dem go soon bring statement about the mata.