The Former Aviation Minister, Femi Fani-Kayode don blow anoda one as hin say the foma president of Nigeria Olusegun Obasanjo Papa fit be Igbo and nor be Yoruba as pipo dey tink.
Fani-Kayode say na cus Obasanjo nor gree tok anytin about the comment wey one Igbo businessman, Emmanuel Iwuanyanwu tok say Yoruba pipo na political jaguda, and as Obasanjo nor tok inside nai be say hin papa na Igbo and nor be Yoruba.
Na wey dem dey do one anniversary for Awka , Anambra State, to take mark govinor Soludo for Office on Saturday, nai Iwuanyanwu take say Igbo pipo nor go take the insult of say make dem komot from where dem don invest put, cus of wetin dey happen for Lagos.
But Fani-Kayode tok for Twitter say hin shock say Obasanjo nor even tok anytin about the statement wey Iwuanyanwu tok against Yoruba.