The light wey nor dey for Ogwuashi-Uku don dey pepper pipo bodi there, come join the over bill wey dem dey get for light don make Beacon Club give two weeks warning to Benin Electricity Distribution Company (BEDC) to resolve their issues or land for court.
Beacon na non-governmental wey dey for Ogwuashi-Uku and dem say make BEDC start to put pre-paid for dem.
Na for letter nai the club take write the warning through Henry Tobechukwu Ogidi. The club say if BEDC nor gree come fix pre paid meter before two weeks finish, if dem reach court BEDC nor go ever kolet the over bill wey dem don nack the community.
The club say dem must make sure say dem stop BEDC make dem nor cut pipo light for Ogwuashi-Uku again cus of say dem never pay light bill untill pre paid meter come.
Dem say if the light company nor folow wetin dem tok, the club go N5 billion damages join the court case..
Tori get am say most pipo wey dey stay for the area, na night from 2-5 for early mormor nai dem take dey get light instead of the six hours BEDC take dey give dem before.