The PDP working committee for Benue don suspend the executives of the party wey dey for Igyorov ward for Gboko LGA for the state.
Na the acting chairman of PDP for the state, Isaac Mffo, nai tell news pipo for Markudi on Thursday.
Mffo say the resin why dem suspend the executive members na to bring sense back to the ward cus of the way dem go suspend Iyorchia Ayu.
And na immediately nai tye acting chairman say dem suspension go last, dem go get am for one month.
Know say na on Sunday nai the ward executive members take suspend Ayu cus dem say hin dey work against the party.