The Department of State Service wey be DSS say dem don find out one plan of Boko Haram say dem wan go attack Abuja-Kaduna train service again some days from naw.
For letter wey the Ministry of Transportation write to Ministry of Defence, then Daily Trust come karey eye touch light am on Thursday, dem say na February 1 nai dem get letter from DSS say Boko Haram dey threaten to come attack Abuja-Kaduna train services again.
The transportation ministry come dey tell the Minister of Defence make dem sharply do meeting with all stakeholders make look how dem go do to stop the attack.
If you remember ma for March 28, 2022, nai terrorists dem go attack Kaduna-Abuja wey many die, some injure and dem tiff others.