+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Boko Haram Wey Repent With Quran Nor Fit Kill Again – Borno Minister

160,000 Boko Haram members nai repent for Borno and di State Govimet say dem don swear with Quran say dem nor go fit go back to dey kill pipo again.

With wetin Zuwaira Gambo di State Commissioner for Women Affairs and Social Development for Borno tok on Wednesday she say dem 70,000 pf di foma Boko Haram members don resettle for inside different communities.

Di minister wey dey in charge of those wey dem rescue and di foma Boko Haram wey don change, say make pipo nor fear at all for di 160,000 men cus as dem don use Quran take oath dem nor fit go back to killing again.

Gambo say pipo dey bad mouth say di terrorists wey dey rise again for North East na cus of di Boko Haram wey repent nai dey still go back to Bush go karey gun to take dey disturb ordinary kontri man.

But for where Minster still dey drag say di foma terrorists nor fit do like that again.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM