Bring The Evidence You Get Against MC Oluomo,Police PRO

The Public Relations Officer for Lagos State Police Command, CSP Olumuyiwa Adejobi, say anybodi wey get proof say the chairman of motor parks wey be Musiliu Akinsaya, aka Mc Oluomo, do against Igbo pipo make the pesin file case against am.

Na Adejobi tok am for Twitter on Tuesday as he dey reply one @AjammaS for Twitter.

@AjammaS, write say: “Sir, you sef dey guilty, if I fit tok. This na wetin you tok for interview for TV interview ‘MC Oluomo’s na just joke, make we take am as joke untill he do am. Make pipo nor fear to come out vote.”

“Now Nigerian don hear you come out to vote but you nor fit protect dem. Dem MC Oluomo and hin boys attack pipo, some die, some wound and even blind, and some still dey for hospital dey take treatment.”

But Adejobi come reply with: “You fit take the case of attack with MC if you get evidence against am. Many pipo and lawyers even the deputy Govinor of Lagos don tok am too. He nor be say police nor fit catch am, so if you get case bring am come.”

“No nid to dey pass judgement or dey for Twitter dey do court trial. E dey very simple. Many of una just dey follow pipo dey tok this mata for Twitter.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM