+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

BRT Bus Jam Train For Lagos, Many Don Die

 

Many pipo don kpai this early morning for accident wey happen between BRT bus and one train around Ikeja side for Lagos State.

The accident happened around 7 today, Thursday and the bus full reach mouth with even govimet workers wey dey go work.

Na one pesin for Twitter @Truthfully83 nai cry come out make pipo dey share wetin happen as BRT Bus don go jam with train, many don die and many injure.

The Twitter pesin say make pipo share the message as the accident pipo nid serious epp.

As e be naw the tokpesin of Lagos State Traffic Management Authority, Taofiq Adebayo, say dem don dey on ground to epp the accident pipo and rush the ones wey neva die.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM