+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Buhari don approve old N200 as money till April 10

 

 

President Muhammadu Buhari don talk say we fit dey use the old N200 notes as money till April 10.

Presido talk this one on Thursday Morning wen he dey talk to naija people .

He say “ For the time wen dem add join the deadline to change old money, I listen to all the solid advice wen citizens and instituitions dey give from all over naija.

“I also ask representative of State Governors and Council of State for their side too. On top of everything, I also take note say this matter dey the table of the courts dem wen dey our land and dem don talk one or two.

“To make things still soft for our citizens, I don give go-ahead to CBN make dem release the old N200 back and make dem allow am flow as money with the new N200,N500, and N1000 notes for 60 days from February 10,2023 go reach April 10 2023 after which the old N200 no go be money again.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM