Dem don sack Michael Akabogu wey be the Managing Director of Nigeria Social Insurance Trust Fund (NSITF).
The resin wey make dem sack am neva come out but e be like say e dey connect to hin fake NYSC discharge certificate.
One insider wey nor gree call he name and dey for the fund confirm to Daily Trust say dem tell am make he go relax untill police finish investigation.
The time wey tori pipo dey call Mrs Ijeoma Oji-Okoronkwo the tokpesin of the fund her number dey off.
Tori bin don come out for news sag the oga of NSITF police call am make hin come ansa kweshun ontop wayo matas before dem dey sack am so.