+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Buhari to Immigration Service: Make Naija border strong Kokoroko

 

 

President Muhammadu Buhari don give order to the Nigeria Immigration Service make dem make sure say Naija border dey strong kokoroko make bad piple no fit enter as we dey prepare for election.

This gist dey for one statement wen Ministry of Interior show news people on Tuesday.

Rauf Aregbesola wen be Minister of Interior nai carry Buhari message through him media adviser Sola Fasure when he dey inaugurate the katsina NIS office and e-passport of the state.

He talk say “President Buhari don give order make dem make Naija border strong so foreign bodies wen wan come manipulate election or do wicked things for Naija no go fit.”

According to wetin Aregebesola talk, presido order na from now till wen Naija finish all election maras, make NIS make sure say nobody fit break tru the country border even after the elections.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM