One seven storey wey dem dey build for First Avenue, Banana Island for Ikoyi Lagos state, fall yakata on Wednesday evening ontop some of the workers.
Tori say many of the pipo wey dey work for the site wound, some of dem jump komot as the building wan fall.
Around 8.30 pm na seven pesin nai dem don fit bring out but others still dey inside.
The tokpesin of Lagos Fire Service and Rescue Service, Amodu Shakiri, confirm am and say dem dey try save pipo lives wey still dey inside.
As e be naw no bodi know why the building fall but NEMA dey try dem best to epp save those wey dey inside.
Afta the pipo wey dem bring out, the Rescue workers say na only one pesin nai remain for dem to bring out.