Businessman Don Dash INEC Returning For Abia Prado SUV

One Steven Ukpabi wey bodi dey sweet am as Abia LP candidate win, don dash the INEC returning officer, Prof. Nnenna Oti wey calculate the result of the March 18 govinorship election.

Ukpabi na from Ututu wey dey for Arochukwu LGA for Abia but dey stay for Abuja.

Na him get Treebones Concept Nigeria Limited, and the CEO of Sungai Pacific Nigeria Limited.

On Thursday nai Ukpabi say why he wan give the land cruiser Prado SUV wey he order for hinsef to Prof. Oti cus she nor allow any bodi use monie take shuk for her mouth.

He say: “I order the car for mysef but cus belle dey tortori me, I don gree to give the motor to Prof. Oti, cus na two weeks ago dem tiff my motor for Abuja.

“As e be now I go give the motor to Prof. Nnenna Oti. I tik say na she nis am pass.”

Na for inside Facebook nai Ukpabi take announce am.

Wetin hin write be say “For wetin you do for Abia pipo, I don say as this Prado land Nigeria next month,  na straight to Mrs Nnenna Nnennaya Oti.

“Thank you for the way you take serve Abia pipo.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM