National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC wan do investigation for indomie cus of one tin inside wey dem say dey cause cancer.
E start from wey Health Officials for Malaysia and Taiwan say dem see one chemical wey be ethylene oxide, and e dey inside indomie spices.
This chemical so, nor get ordour and color and dem dey use am take dey treat hospital tins so that e nor go get infection and dem say this chemical dey cause cancer.
Cus of wetin Malaysia and Taiwan see the two kontri don shift bodi komot from the product.
But Indofood wey dey make indomie say the chemical wey dem dey put nor dey bad to eat.
Taufik Wiraatmadja, one member of the board of directors for Indofoods, say indomie get standard to produce before dem start and even the noodles get international regulations.
The director general of NAFDAC, Mojisola Adeyeye say the agency go soon start to dey test indomie and other products from May 2.
Adeyeye say NAFDAC start investigation immediately dem hear say Taiwan and Malaysia don stop to use the food.
The DG say the product don dey wetin FG govimet say dem nor want again and e nor even dey register with NAFDAC plus say dem don stop to bring am come the kontri many years ago.
She come say NAFDAC dey work to make sure say dem nor pass backyard take bring am enta Nigeria and dem go tell Nigeria pipo anytin wey come out from the investigation.
As e be now na Nigeria nai dey eat indomie pass for the world as of May 2020.