Church Choir Nai Epp Me Do Well: Okowa

Govinor Ifeanyi Okowa say the resin why hin do well for office na God wey use choir for Govimet House Chapel nai make am do well.

Na wey the choir dey launch dem music on Tuesday for Asaba hin take tok so.

Okowa say one of the biggest tin wey he go give Sheriff Oborevwori the govinor elect go be the presence of God for the govimet house.

“We thank God say our govinor elect and hin deputy dey here  the biggest desire if me and my wife na to see say the fire for this altar kwatinue to dey burn.”

Okowa come still say, “Different voice go come to only to confuse dem but na to give deaf ear and just focus on God.

The govinor come dey advise Oborevwori make him no slack to dey serve God even as dem dey prepare to take the mantle of leader for the state.

He say with beta service to God all okamuka go komot from road, and the music album go epp karey the gospel of God far and make pipo support the choir, buy dem CD.

Govinor Okowa say “We nid encourage this choir cus through dem voice, the praises and worship wey dem dey do here, many tins don happen for this state.”

“We fit no like am, but me and my wife believe God inside the chapel. We know say God presence dey this place, and anytime wey we call he dey answer us.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM