As election go soon happen for Nigeria Commonwealth observer mission to Nigeria don sitdon with INEC chairmo, Prof. Mahmood Yakubu to resin how the elections go take go well.
The oga kpatakpata of the Mission na Thabo Mbeki and na foma President for South Africa, hin say the resin for the meeting na to hear from INEC if dem don really ready for 2023 election.
He say afta the election finish the mission go write about wetin dem too see.
Mbeki say Nigeria dey very important to Commonwealth and dem dey get mind say the election nor go get wayo and woruworu.
“We come with awa chairpesin support.
“We tell tori pipo this morning say this na the seven time wey wey dey come observe Nigeria election.
“Nigeria dey very important. E social impact dey touch commonwealth and other kontris. So nai make Commonwealth come to observe this election.
“We dey believe say everytin go dey peaceful but that one depend on you and INEC.
“Nai make we come to hear and to know how you don prepare reach. Wey the election finish we go still tok wetin we see.”