President Muhammadu Buhari dey sitdon do Council of State meeting to see how dem fit take solve this naira new policy wey dey make every bodi eye dey shook find monie.
Main resin for the meeting na to discuss some of the issues wey dey disturb the kontri like fuel, monie, insecurity and plenty others as election go soon reach.
The meeting start by 10:12 am afta dem sing national anthem finish, and e dey happen for Council Chambers of the Presidential Villa inside Abuja.
Foma heads of state and presidents wey dey the meeting na Gen. Yakubu Gowon (retd), Gen. Abdulsalami Abubakar, and Goodluck Jonathan.
While former President Olusegun Obasanjo joined online with other govinors.
Then Vice President Yemi Osinbajo, President of Senate, Ahmed Lawan; Speaker of the House of Representatives, Femi Gbajabiamila; Attorney General of the Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami; Secretary to the Government of the Federation, Boss Mustapha; and Head of Service of the Federation, Folashade Yemi-Esan all of dem nai dey there.