Justice Vera Agbodje for Delta State High Court say make Kenneth Gbagi and hin Signatious Hotel for Uvwie Local Government, pay N1 million give one Mr Victor Ephraim wey karey case come say dem nor treat am well.
Ephraim tok through him lawyer, Mr. Kunle Edun, for September 17 and 18, 2020, say no be small pepper nai Gbagi tell him security pipo make dem give am plus three other female staff for the hotel afta dem accuse dem say moni wey guest pay for hotel dem chop am.
He say dem use force take kolet dem ATM card take transfer money go the hotel account as the security dey beat dem.
Justice Agbodje say make Gbagi karey he tok go front as na lie hin dey tok, then she say make Gbagi pay N1 million give Ephraim e foma worker.
Know say Gbagi nai be the govinorship candidate for Social Democratic Party, SDP, for Delta state, hin say he don appeal the judgment wey the judge give.