+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Adeleke Nor Fit Epp Melaye For Kogi, 2026 Don Finish For Am —Osun APC

APC for Osun State dey laugh Govinor Ademola Adeleke say for 2026 hin go hear oba as hin nor fit make PDP candidate for Kogi State , Dino Melaye win di Saturday election for di state.

Na for statement wey di chairman of Osun State, Tajudeen Lawal, sign nai APC take say Adeleke just open hin hinsef say he nor fit win any election cus he nor even fit try small make Melaye win even though say na him be di campaign chairman of di party.

Lawal say di way dem take win Adeleke for Kogi State na to tell Osun pipo make dem get up from sleep and shift Adeleke komot from power for 2026.

“Make wetin happen for Kogi State govinorship election be example for Adeleke, to show say na empty kpangolo nai dey make noise pass.

“As Melaye don loss for di election for Kogi na di mirror of wetin go happen for Osun 2026 govinorship election be that.

“As e be naw, Adeleke you and your padi nor get where una wan put face.

“My party, APC, go use normal way take office and  komot you from govinor seat for 2026 governorship elections.”

Lawal come still say na wayo nai Adeleke take win for Osun state govinorship election wey even make more than 30 APC members doe due to PDP gbege.

He come tell Gov Adeleke make hin share di N9 billion fuel subsidy monie wey FG give for palliatives, cus pipo dey wait for am to see wetin he don do as he first year anniversary for office na just some days from now.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM