+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Stop CBN Make Dem Nor Extend Old Naira To Feb 10

 

 

 

One High Court for Abuja don drop am for CBN bodi make dem kwatinue dem full policy for the monie wey dem change.

For the ruling wey the court give on Monday, the court stop CBN say make dem nor karey the date wey dem go take change the old monie go front.

Na CBN, Presido Muhammadu Buhari, and some other banks nai dey for the case.

The pipo wey karey the case go court  na Action Alliance (AA), Action Peoples Party (APP), Allied Peoples Movement (APM), and National Rescue Movement (NRM).

Eleojo Enenche, wey be the judge tell CBN make dem nor karey the date go front untill the case go finish.

The judge still say make CBN, staff, agents, officers, and anybody wey dem hand dey for monie follow the order ontop old N200, N500, and N1000 before 10th of February, 2023, before dem go hear the case again.

This order go dey for seven days until dem go hear  motion of notice for February 14.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM