Industrial Court for Owerri don give short order to Nigerian Labour Congress, NLC and Trade Union Congress, TUC make dem nor do any strike for Imo state.
The judge, Nelson Ogbuanya, nai give the order on Thursday.
The judge still tell NLC and TUC or any bodi wey join dem , make dem nor stop to dey work untill court judge the case wey the state govimet bring come
The judge come still give the state govimet go ahead to give the real notice and tell NLC make dem nor near come stop anytin.
The case don go May 11 to start anoda judgement.
Organised labour bin do strike cause of the way dem stop workers day celebration for Imo state on Monday.
But Philip Nwansi, wey be Imo chairman of the NLC say the workers for the state nor go join the strike wey the leadership of the congress declare.
He stand say workers get big togedanes with the state govimet so dem nor no nid the strike.