One of the Fediral High Court wey dey for Lagos don stop INEC make dem nor use the Chairman of Lagos Parks and Garages, Musiliu Akinsanya, aka MC Oluomo take distribute election material and ad-hoc staff for the state for this election wey dey come on Saturday.
Na Justice Chukwujekwu Aneke nai judge the case afta the Labour Party govinorship candidate for Lagos state, Gbaddbo Rhodes-Vivour karey the mata go court.