David Adeleke aka Davido dey ready hin clothe to go Forbes 2023 ‘Under 30 Summit’.
The program go happen for Gaborone, Botswana on April 23 to 29 and OBO go sing and still tok with the pipo.
Na for Twitter nai Davido take tok am, hin say: “I go perform and tok for 2023 @Forbes #Under30Summit Africa wey go happen for Gaborone, Botswana on April 23-26!”
According to Forbes, this one dey follow afta the first Forbes Under 30 Summit Africa wey dem do for April 2022.
This program na for young entrepreneurs and game-changers and dem go gather again for Botswana.