Delta CJ Want Make Dem Free 8 Prison Men

The one wey dem dey call Conference for the Actualisation of Human Rights, CAHR, don put woto for the Chief Judge and Prison Controller of Delta state bodi make dem free one Mr Isiah Mumbor, plus seven oda pesin, say dem don stay for prison pass the years wey dem suppose stay.

Na Mr Omes Ogedegbe wey be the group coordinate nai tell news men for Warri say the the two men don serve jail for pass the ten years wey court give dem, so e beta make dem free.

He say the years don pass cus dem time for prison start from on the 13 of December 2016, and dem don do seven years straight before, then wey you put the remission style, you go see say dem don do pass the years wey court give dem.

He come call the names of the pipo wey suppose come out as Isaiah Mumbor wey dey for Kwale prison, Ife Freedom, Warri prison, Sunday Uba Tiemo, Warri prison, Ernest Ateh, Whitehouse, Benin,  John Adapamo, Oko prison for Edo State, God’spower Omoniyi, Enugu Maximum prison, Kemi Konyain, Warri and God’spower Ikoro, for Agbor prison for Delta State.

Ogedegbe come say make the lawyer look for the mata and free the men.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM