Delta Police Save Two Pipo From Kidnapers For Ughelli

Police for Delta State save two pipo wey Kidnaper wan tiff for ECN Junction along Agbarho-Ughelli Road.

Wetin police come see for the kidnapers hand na 26 Android phones, one local single barrel gun, 38 rounds of live cartridges, 2 cartridges, 2 Moniepoint POS, 4 power banks join with two empty women handbag.

The keke wey the tiff kidnaper use, Police kolet àm back.

For April 24, 2023, around 2:00 for afternoon nai the DPO of Owvian Aladja, CSP Aliyu Shaba, get call say four men wey dey keke don tiff Ovigwe Dagagba wey be 31 and Obinna Nwanko 29, and dem two dey stay for Usiefurun community for Ughelli South.

The kidnappers had reportedly conveyed them in a Toyota Corolla car belonging to one of the victims from the Usiefurun roundabout and headed towards Udu Local Government Area.

Nai the DPO and hin team come start to dey porshoe the kidnapers reach ECN Junction for along Agbarho-Ughelli Road

As the police and kidnaper dey shoot like Rambo film , nai dem run leave dem motor and the pipo wey dem don tiff.

Wey police dey confirm the mata through Confirming the incident, the state Police Public Relations Officer, DSP Bright Edafe, the police PRO say even as dem dey fight the Deputy Commissioner of Police wey dey in charge of Operations, DCP Johnson Ademola, say make dem kwatinue with this kind energy to stop crime.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM