Delta YPP Candidate Wan Take Nigeria Go EU Cus Of Election Wayo

 

Young Progressives Party Govor candidate for Delta State, Sunny Ofehe, say hin nor just happy with the way the Feb 25 and March 18 election go.

Ofehe, na pesin wey dey stay for Netherlands, obodo oyibo but come back Nigeria for the election, say hin nor just happy with the way the election go.

Wey hin dey tok to news pipo for Abuja on Wednesday, Ofehe say instead of am to use the petition tribunal he go karey Nigeria go European Union and other international agencies to make sure say dem get the normal sanctions.

He say “We nor fit allow dem monitor our election finish d the only tin wey dem do na to give only statement.

“Action suppose folow so that e go put pressure for INEC bodi and oda stakeholders to do the right tin next time. Pipo nid get punishment, I don already start the process and I get enough evidence to back am up.

“I nor go waste my time to use the tribunal cus I nor believe am. But I go epp the kontri with the international contacts and networks wey I get to go meet EU and odas.

“I be Nigeria wey dey stay for Netherlands. I come here to vote and make dem vote for me wetin I see nor suppose to dey happen this kind time. Dem sell Democracy. The pipo wey suppose protect the process na dem even dey do worst.

“This election just full with wayo, and as human being and political rights activist, I go enta anywhere for the world to tok about this shame of election. This nor be democracy wey I gree go join.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM