The candidate from Labour Party wey wan be senator for Enugu East, Prof Oyibo Chukwu, some pipo don go kill am before the election on Saturday even reach.
Tori get am say dem burn Chukwu and other of hin party members on Wednesday night for Amaechi Awkunanaw inside Enugu South LGA.
Dem say na pipo wey dem no know nai waylay dem as for inside sienna motor before dem put fire. Like give pipo nai the fire touch.
One source say “Na really sad tin happen, we get to know say dem burn dem with the campaign motor. I nor fit tok pass like this cus I nor be family member.”
From police side, dem neva tok anytin yet.