Everywhere don quiet for oga Tinubu, president elect camp afta hin Guinean passport show like spirit for social media.
The tin just make everybodi dey wonder and tik why Oga Presido elect lie give INEC.
Na on Saturday midnite nai David Hundeyin wey dey run hin own parole for news, put one Guinean passport wey get the name and face of Bola Ahmed Tinubu for hin Twitter hakant.
The passport get Tinubu face and Guinean give am for October 2015, then e go expire afta October 2020 to make am five years
Dem say na wey Alpha Conde be president for Guinean nai he take give Tinubu, cus even Tinubu don come out tok say na him epp Conde wey he take win the October 2015 election before military coup come komot am for 2021.
As the mata dey make noise like fly for social media, dem Dele Alake, Festus Keyamo and Bayo Onanuga, just dey avoid the mata. Even wey dem try to hear from Keyamo and Onanuga on Sunday, the two nor gree go that side.
But Alake say hin not get anytin to tok about the two passport wey Tinubu get and how he take lie for INEC say na only Nigeria passport hin get.
Even pipo like dem Segun Dada and Jubril Gawat wey dey make noise for social media to defend oga Tinubu, just kip kwayte.
The two passport mata just make Presido elect dey trend for Twitter, come join the case wey dey for court about the tins wey happen for Feb 25 election.