Nigerian Association of Resident Doctors don tell dem members make dem go back to work today Monday afta the five days warning strike.
Na afta NARD do three hours Extraordinary National Executive Council meeting finish nai dem take say dem go look weda FG really serious to quech all the issue wey dem raise before two weeks finish.
Dem NARD come sign MoU with FG on Friday to tok about wetin dey pain the resident dokitors dem.
Remember say na for May 17 nai NARD take strike say make FG do wetin dem ask from dem.
For interview wey the president the association, Dr Emeka Orji tdey folow tori pesin tok, he say dem don stop the strike today wey be Monday.
He say the association go look the way the progress dey go for dem general meeting for Lagos, and na till June 2, 2023 dem go take anoda leg.
Then the Publicity, and Social Seketary for the association, Dr Umar Usman, say before dem strike dem do National Executive Council meeting and na the council nai stand for awa back, we come enta 5 days strike, afta all we go let dem know how far we go.