+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Dortmund: Brandt go miss two games cos of injury

 

 

Borussia Dortmund don announce say their midfielder Julian Brandt no go play for any game for two weeks based on say he thigh muscle tear.

Dortmund substitute the Germany midfielder comot after just five minutes for the 2-0 game wen dem play with Chelsea on Tuesday. That game nai Chelsea take send Dortmund comot for the 2nd leg of Champions League round 16.

The club tweet say Bradndt “ muscle fibre for thigh tear” and so he go miss the club derby match for Schalke and their home match against Cologne.

Brandt don score for four of him five league matches and dem even name am Bundesliga player of February.

Dortmund win their last eight league games. Them dey side by side with Bayern Munich for points on top the table and second for goal difference.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM