Double Wahala For Deadi Bodi For Bayelsa Community Cus Of N50

Keke man wey go shuk one young guy die for Yenizue-Epie community for Yenagoa, pipo don garda am beat on Wednesday.

The youth wey the keke man kill na Douglas Joseph wey be 30 years, get three children and na from the community.

One witness wey tell DAILY POST say dem dey outside near Saptex junction for Yenizue-Epie, wey dem see say Joseph and the keke man dey argue.

“He say hin dey come from Opolo community to Kpansia and the price suppose be  N100, but the keke man say na N150 hin go kolet.

“As we  dey try stop dem, na so the keke man bring out dagger. We tik say na to make us fear and run. But he  come use am shook he lap, naso he fall for ground. Pipo nor come allow the keke man run. But the mata nor come good as tye passenger come die. As pipo see say the guy don die nai dem land the keke man with different wood and tins for bodi before dem put am fire”

The Bayelsa State Police Command, say dem don send dem Anti Riot Squad to make sure say Kpansia normal again afta the keke man dein go kill youth for the community.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM