Draw Ear Strike Nai Dokitors Wan Give FG Tomorrow

The bodi wey dey cover dokitors for the kontri, Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) say dem go start strike tomorrow for five days as Fediral Govimet nor wan gree hear wetin dem dey ask for.

Yesterday nai the National Executive Council do meeting for six hours afta, the meeting nai dem gree say na strike from on go win am and e go start tomorrow by 8:00 to Monday, May 22, 8:00 for morning.

The dokitors dem for April 29 don bin give two weeks warning to FG wey end on Saturday.

NEC say na as govimet nor gree call or even come meet dem for meeting nai make dem enta the five days warning strike.

Dem dey hope say during the strike, govimet go tok beta tin.

But NARD say if the new govimet wey wan come nor do well na full strike wey dem nor go look back nai dem go do for the kontri.

Dr. Emeka Orji the NARD president come dey call president elect, Bola Tinubu to karey hin experience to use stop all this wahala, cus if hin do so e go give hope to pipo.

Join wetin dem dey ask, na make DF increase dem salary with 200%, to pay the 2023 Medical Residency Training Fund and tell the House of Rep make dem troway that bill wey Ganiyu Johnson bring say make young dokitors nor dey japa unless dem don work 5 years for Nigeria.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM