Somebodi wey dey driver motor don go jam two brodas die for Isolo inside Lagos state, one of dem na Abibu Bello wey be 17 and Bolaji wey be 14, then come wound anoda pesin for Iyewa street.
The story dey come say the driver wey be woman, just komot from hairdresser salon dey drive go one place for the area, wey the motor just lost control come run go enta the building where the two brodas dey play.
Somebodi for the area say the children wey die, dem papa na politician.
The pesin wen say make dem nor call hin name con explain wetin happen: The accident happen around 7.40pm. The motor first jam kiosk for the building front before e jam the main building.
“Out of the three children, two die instanter. Dem papa na politician for the area. The other piken na neighbor get am. He leg break and dem dey treat am for Isolo general hospital.”
Punch tok say dem get to know say even the driver of the motor get wound for bodi and dey for hospital.
Some part of the Chairman pipo for Isolo LGA, wey Bayo Olasoju lead go the area, naso pipo full there dey cry.
The state Police Public Relations Officer, SP Benjamin Hundeyin, don confimate the accident.