Anoda earthquake don nack Turkey-Syria border. This new earthquake dey happen afta the first one wey happen some days ago and kill more than 40,000 pipo.
Wetin Syria’s state news agency (SANA) tok, the 6.4-magnitude earthquake hit Turkey Hatay province wey shake the time wey the first earthquake happen.
For Syria.dem say six pipo injured forAleppo as the building dey fall while for Turkey different building fall with many pipo still dey under the building wey fall.
Turkey state Agency wey be Anadolu say pipo wey dey for Syria, Jordan, Israel, and Egypt dem hear the earthquake.
The side wey the earthquake touch for Syria no get light and internet again as many pipo dey run komot dey stay for where dey open.
The Syrian authorities don tell dem kontri pipo how dem go take know say earthquake wan happen and how to run quick komot.