Chief Judge for Court of Appeal, Monica Mensem, say make the Ebonyi State Election Petition Tribunal karey dem kaya sharply and go back to Abuja.
Na the seke of the Tribunal, Nyior Henry Sekulla nai announce wetin Mensem tok on Wednesday for Abakaliki.
Sekulla say afta the order, the Election Petition Tribunal office for Ebonyi Judiciary Headkwatas for Abakaliki don close.
“The Hon. Justice Monica Dongban Mensem, President Court of Appeal – HPCA don tok through hin Deputy Chief Registrar, Election Petition Tribunal (EPT) Headkwata for Abuja don tell EPT here make dem come Abuja.”