Provocation still dey some pipo belle for the tin wey happen for the presidential election February 25, afta INEC announce Bola Tinubu as the winner.
One video wey dey trend for social media, show one babalawo for Edo State as hin dey curse INEC Chairman, Prof Mahmood Yakubu and the odas say na dem play wayo for the election.
Hin say as e be naw INEC officials dem dey play with dem life , as he don call the gods of Benin make e deal with the pipo wey dem hand dey for the election magomago before May go finish.
“INEC chairman karey Peter Obi result take go give anoda. You don take the glory of the land give wrong pesin. Today I don call death to pursue you.
Know say the result of the presidential election, Atiku Abubakar of PDP and Peter Obi of LP.